I tanda for my doormot dey browse my dream Bugatti Veyron moto
I com see Odeku run go wear knicker
Wan fight woman
To show say im be man.

************************

Dis mumu man no get sense o
You no sabi who woman be
She be descendant of Eve
The Mama of ya mama.

************************

Na she mould you for her belle like eba
Na she bake you for the oven of her womb
Na she teach you to waka and to talk talk
Who sai, dog wey wan lost no dey hear hunter whistle .

************************

Woman na like water wey turn to erosion
Day by day e dey comot you, and you no go know
Till the day wey you go disappear
You go think say you dey win when you don loose.

Woman na Church
Woman na war zone
Na you go chose the one wey you want
Odeku no gree, he has to beat a woman to show he is a man.

************************

Odeku nack d woman two blow for face gbosa, gbosa
D woman kwa vex carry am with im biabia knack odeku for ground, gbagaa
She pack sand sand pour am full im mouth like garri
Till Baba Kamo rush to seperate dem as she don disgrace Odeku too much.

************************

Since dat dey, Odeku too don dey tanda for im door jejely
Pim, like dis e no dey talk for yard again
Auntie Patty our compound CNN say Odeku say im don born again
Who dem go knack for ground like dat wey no go born again.
Selah.

To read another one, match ground for here jare Standing by my door

All the mumu people wey dey beat woman to show say dem be man. Make una go barrack or motor park go try power nau. Me I tanda here for my doormot dey drink my kunu jejely. Abi my people how una see de mata. Knack me ya commentary for down below make gist full ground like fried rice joo.

Na me be dis.
Da one and da only Ogbonge Traffling Poet wey full ground gidigba for efry where.

UNA DO O.


16 Comments

Tunde Akinseye · August 29, 2020 at 5:26 am

Hilarious 😄😄😄

    Benedicta Saroh · August 29, 2020 at 5:42 am

    This ya dormot sef….🤣🤣🤣🤣🤣🤣

      Ovyay · August 29, 2020 at 6:09 am

      Na so. Wetin pesin no go see for hia 🤣🤣

    Ovyay · August 29, 2020 at 6:08 am

    Thanks jare🤣🤣🤣

KG · August 29, 2020 at 5:37 am

Can’t stop laughing. Reminds me of a woman I I was counselling. Her own odeku don de beat am for years. One day she raise hand back as she don taya. She come see say Odeku sef no get power. She beat sege commot for him body. He run away. After that day Odeku no dare touch her again o. Anytime Odeku start wahala, she go remind am of the last beating and him go tanda for far de shout. 😁😜😜😅🤣😂 A CAPTAL NO TO DOMESTIC VIOLENCE.

    Ovyay · August 29, 2020 at 6:08 am

    True talk lo sọ yẹn 👍🌹

Femare · August 29, 2020 at 5:42 am

Hilarious, good one…

    Ovyay · August 29, 2020 at 6:07 am

    Thank you so much Fe👍👍

Milla · August 29, 2020 at 3:35 pm

😆👍

    Ovyay · August 29, 2020 at 4:41 pm

    Thanks Milla

Regina Ofonime johnson · August 29, 2020 at 8:25 pm

Odeku see something wit he own eyes nobody tellam anything own his own he become by force born again. Daddy in this your doormoot you dey see plenty things ooh.

    Ovyay · August 29, 2020 at 9:07 pm

    Na so I see am o 😂😂😂

Shawn · August 30, 2020 at 5:39 am

Na so o, na mumu go beat or hit a woman. Thanks sir likr my children go say. Na WORD

    Ovyay · August 30, 2020 at 5:43 am

    Thanks Shawn. I appreciate your comments.👍

Esu Agbaedeng · October 3, 2020 at 8:22 am

Nice one sir as much as I don’t support any man beating up a woman and I think that any man that does so should be flogged but what about women that verbally abuse their husbands nko. Probably you should write one poem on that line

    Ovyay · October 3, 2020 at 9:17 am

    Eh, OK o. Make we dey see now. If the inspiration comes 😂

Leave a Reply

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

Subscribe Now

Love our poems and stories ?

Subscribe to our mailing list and get notification when ever we post any new content

we hate spam and we promise to never share or sell your email