I dey my doormot, dey look rain wey dey fall, stop and start again
Naim I come tell the rain
Bros, see wetin you cause for ya self
Common to fall, you no sabi again.

*******’****************

Night don come
Everywhere dey dudu
Wey the moon nau
Abi im don begin wear nose mask?

************************

Evening come
I carry camera to snap sunset
Na there I tanda, so tay mosquitos chop my leg finish
Our sin don too much, even sun don taya for we matter.

************************

Baba Kamo where you dey go for this early momo
I dey go collect my N350 wey dey for bank month don end
Why nau,
Make I see how dem go comot card maintaince charge if money no dey am.

************************

Odeku beat im pickin, nearly kill am dis afternoon
Oga, wetin dis pickin do nau
Everyday immediately e chop finish, e go go shit, dey waste my food
Kai, this life no balance again o.

************************

How e go balance wen egungun don dey sing gospel

Goat dey chop paper

Dog sef don begin dey chop gworo

For Aunty Patty shop, rat don drink all the Alomo finish.

*****************’******

You off shirt, cold go catch you
You wear shirt, heat wan kill man
I beg make I enter house go browse internet
Maybe Bugatti Veyron price don come down.
Selah.

You wan read anoder one, mash ground for here Standing by my door

Hope you gbadun di tory wey you read so? Oya comment for below make I know how the gbedu wey dey the tory enter you for body.

Till next time.
Buy ponmo, before you buy data.
Una do o.


18 Comments

Femare · August 22, 2020 at 4:39 am

Hilarious, thanks sir

    Ovyay · August 22, 2020 at 5:11 am

    You are welcome Fe

Adanma Okoroafor · August 22, 2020 at 4:43 am

When you said โ€˜abi task force don catch am because e no wear face maskโ€™ that was it for me. I just started laughing.

    Ovyay · August 22, 2020 at 5:10 am

    Ada, you sabi humor joo. Chop life, God dey with you joo๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚

KG · August 22, 2020 at 6:05 am

๐Ÿ˜๐Ÿ˜๐Ÿ˜Lobatan o. Me I know say the life no balance again when vigilante begin do watchnight work for Police station.

    Ovyay · August 22, 2020 at 7:53 am

    Hmm, wahala dey o. But God senior am.

Ovis · August 22, 2020 at 7:24 am

Na So E Don Be…Nepa Office Don Go Buy New Generator

    Ovyay · August 22, 2020 at 7:51 am

    Ehen, true talk

Tele philemontele · August 22, 2020 at 7:49 am

Smiles , so funny but that’s the reality of our nation Nigeria today. God we need your mercy.

    Ovyay · August 22, 2020 at 7:50 am

    A big Amen to that.

Dabira · August 22, 2020 at 8:41 am

๐Ÿ˜….. another funny piece daddy. God bless you sir.
..dat odeku..I feel his pain.. literally David these days๐Ÿคง.
My mom said he’s doing like bird๐Ÿ˜‚

    Ovyay · August 22, 2020 at 8:50 am

    God bless you too Dabisco. Thanks.

    Abamba prince · August 22, 2020 at 9:40 pm

    “Everywhere don dudu,”that was it for me,
    Thank you daddy.

      Ovyay · August 23, 2020 at 4:04 am

      Na so o ๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚

Benedicta Saroh · August 22, 2020 at 9:24 am

Hahahhahahahahahahaha…..laff wan tear my belle

    Ovyay · August 22, 2020 at 9:25 am

    Benee thanks

Olalekan Adedeji · September 2, 2020 at 12:28 am

Even the internet refuse to browse after I don put keyword .
This life get as the tin be.
Boss I salute your pen on paper.
Make I Tanda praise God small

    Ovyay · September 2, 2020 at 5:10 am

    Amenooooo ๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚

Leave a Reply

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

Subscribe Now

Love our poems and stories ?

Subscribe to our mailing list and get notification when ever we post any new content

we hate spam and we promise to never share or sell your email