Covid – 19, just dey ya dey. All dis wan wey you dey para for road, na ya sef you go kill. Ya egungun don enter express. Na to peme remain. I put you on lockdown and kwarantine you to hell faya till lailai in Jesus name Glorified. Amen.

One dey, I just dey my dey, naim I com begin write.

Covid dey ginger for outside

Hunger dey woz me for inside

I try to pam, the thing no work

Ọmọ ìyá, lockdown don turn to knockdown o.

Abeg, who sabi the ancestor wey I offend.

I dream wan kain dream like dat

Say for Naija, we pipu no dey use generator again

So I woke and whilst rubbing my eyes

My neighbor started his genset.

Ogbeni, ji ma sún.

There was light in the morning

There was light in the afternoon

There was light at night

For midnight, I no fit sleep because I dey sure say yawa do gas somewhere.

How light go dey since morning?

Waiting for palliatives

Spent the whole day waiting for palliatives

Slept at night and dreamt I was waiting for palliatives

Woke up the next morning, still waiting for palliatives…

Tuale Iya mi, abeg, wetin be dis paliatives sef ?

SELAH.

To read another Poem, click this link Traveling companions and compatriots

Abeg how your side for dis covid time.

Talk am as e be you for comment section for down down below.

Una, we dey God hand o.

Say Amen.

Till next time.


22 Comments

KG · May 16, 2020 at 5:36 am

Haaaa me I taya for dis okwerena firus o. I don wash hand taya. Cover nose to breathe na wahala. Garri for custard na two tasand. Gofment de bring palliiityyy, we no see am. Okwerena abeg pack and goooo. Only consolation be say for we Naija we de survival anything because we God de look us no de comot eye for we bodi.

    Ovyay · May 16, 2020 at 5:42 am

    Gbam, ✅

Lordside · May 16, 2020 at 5:52 am

See dis strange visitor wee come this period no ba am o, na every seconds by question and as I dey answer one naso answer go belle another question just becos cofid dey outside dey Waka like a lion who swallow person. Worst,k na so so food Dem eat and ayme I don turn to 0 0 1. But God go help us finish the kofid holiday in peace.

    Ovyay · May 16, 2020 at 6:15 am

    Na so my brother. Na God hand we dey o😂😂

Kay · May 16, 2020 at 6:12 am

Aaaah! For dis side, we dey kampe bicos Baba God stand gidigba for awa side. No shaking! Mek rona carry im wahala go wia im from com o! Infact, rona, your egungun wey dance enter express don die! Fayaaaaaaaa 🔥 🔥 🔥 🔥 🔥

    Ovyay · May 16, 2020 at 6:17 am

    I trust you. You carry faya bury am. Na I’m portion be dat😂😂

Ovis · May 16, 2020 at 6:20 am

Miss Rona No Fit Shake Me. We bam for my side, everywhere stew, everything nice. Make Covikk 19 Virus
Shapaly Clear Road Make All Men Step Outside😁😂

    Ovyay · May 16, 2020 at 6:42 am

    Na so e go be. You don talk am finish 👍👍

Oluchi · May 16, 2020 at 7:32 am

Lol this one funny. E no easy o but we go survive.

    Ovyay · May 16, 2020 at 7:57 am

    Amen o. Na correct prayer be dat.

Lalibra Posh · May 16, 2020 at 8:28 am

The matter self taya me o. We don knockdown o but we dey hope baba God go save us soon. Make he forgive us our sins

    Ovyay · May 16, 2020 at 8:29 am

    Na so o. You don talk true thing. Na God hand we dey now. 👍👍👍

Regina Ofonime johnson · May 16, 2020 at 5:07 pm

This wahala wey dey call covid 19 don make me wash hand sote sote and cover nose tire, for this my end people wey I hear say they collect palliative was 2cups of garri, 2cups of rice and a cup of flour. Even now I dey hear say some cancellors dey sell rice, garri and flour now.

    Ovyay · May 16, 2020 at 5:47 pm

    Kai Naija, na only God fit help us.

Promise Uche · May 16, 2020 at 8:59 pm

That is naija for today. God will deliver us from this prison one day.

    Ovyay · May 17, 2020 at 4:33 am

    Amenooooo

Bunmi Julius · May 17, 2020 at 4:05 am

Daddy na God hand we Dey ooo, and He will surely see us through by his grace.

    Ovyay · May 17, 2020 at 4:32 am

    A big Big Amen to that Iya too

Femare · May 23, 2020 at 10:55 am

God will help us, nice play on words, always enjoy your poems sir. Thank you.

    Ovyay · May 23, 2020 at 11:19 am

    You are welcome Fe.

Olabisi seun · May 23, 2020 at 9:59 pm

Na God go help us for this country people wey don tee u see last u no feel hug them because of covid 19 8pm police dey pursue people as if we be thieves may God help us l don’t tired oooo

    Ovyay · May 23, 2020 at 10:01 pm

    No be you only o

Leave a Reply

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

Subscribe Now

Love our poems and stories ?

Subscribe to our mailing list and get notification when ever we post any new content

we hate spam and we promise to never share or sell your email